Tunde Ososanya, Annette Arotiba and Adebola Ajayi
Na here we go end our live coverage of Day Two of di protests across Nigeria.
You fit scroll down to catch up on wetin happun today.
Thank you for following us.
Bye-bye!
Protesters across Nigeria still dey ginger wit dia demands to End bad goment for di kontri.
Friday protest bin dey mostly peaceful across di kontri but for di nation capital Abuja, police fire tear gas to stop protesters wey bin dey march go di city center and oda satellite towns.
In case you miss am, dis na di highlights of Day Two protests for Nigeria.
Amnesty International condemn di killing of protesters by security officials for Nigeria.
Nigeria former vice president Atiku Abubakar give im support to di ongoing nationwide protest against hunger for di kontri,
Nigeria Police Force place all units on red alert.
Nigeria Minister of Communication Innovation and Digital Economy, Bosun Tijani, deny say goment give instruction to network providers to disrupt di internet connection of Nigerians.
Banks, shops, business still sey shutdown.
Many shops, banks and business dem still remain closed on Friday, sake of di nationwide protest.
For Lagos, wey be di commercial center, business activities shutdown.
Most business pipo ask dia staff to work from home.
Meanwhile for Kano, wey dey di northern part f di kontri, government partially relax curfew to allow pipo observe Jumat prayers. Shop owners also protect dia properties afta jaguda pipo enta pipo shops and tiff plenty tins on Thursday.
Borno state also relax curfew.
Meanwhile for di south-eastern part of di kontri major streets and cities bin dey empty.
Di residents for Imo, Enugu, Anambra, Abia and Ebonyi no join di protest.
Kano Police say dem arrest a total of three hundred and twenty-six (326) suspects wit plenti exhibits.
Di exhibit include two (2) AK-47 rifles wey dem loot from Audu Bako Secretariat and High Court Complex wey dem recover, during di EndBadGovernment protest wey happun for Kano on 1st August 2024 Nationwide protest.
Tok-tok person for Kano police, Abdullahi Haruna Kiyawa, na im yarn dis one for press conference on Friday for Kano Police Headquarters.
E tok say di Commissioner of Police, Kano State Police Command, CP Salman Dogo Garba don direct di Anti-Cyber Crime Unit of di Command make dem launch investigation to fit arrest and prosecute di pipo wey do dis bad tins wey fit make di public turn against di police.
Wia dis foto come from, Photo credit is NLC/X
Nigeria Labour Congress, NLC, don clarify one statement wey say dem no dey re-consider or suspend di nationwide protests.
For statement by Benson Upah Head of Information and Public Affairs, NLC say di statement get nothing to do with di on-going national protests.
"Di statement in circulation bin dey published after we rub mind with government on matters including government observance in breach of di MoU e sign with us on June 5, 2023.
We find am necessary to say for our statements of July 22nd and 23rd 2024, we bin advise government to dialogue with di leaders instead of engaging in tok-tok wey no dey helpful, as e bin dey within dia constitutional right to protest.
Our position on government meeting with and engaging in sincere dialogue with di leaders of dis action never change. E remain di best way to go." Di statement tok.
Protesters begin pick dirty wey dem use round di Freedom park for Ojota, Lagos state wia protest dey go on.
Some of di protesters bin form sanitation unit so dem go fit keep di protest ground clean.
Wia dis foto come from, Getty Images
Human rights group Amnesty International, don condemn di killing of protesters by security officials for Nigeria.
Di head of di Nigerian office of di group, Isa Sanusi, tok inside one statement on Friday say 13 pipo die on di first day of protest, while dozens injure. Dis na di report of one private security company for Nigeria – Beacon Consulting, dem put di number of pipo wey die at 20.
Both organisations agree say six pipo die for Suleja, one community for central Niger state wey dey share boundary wit di capital, Abuja, while four pipo die for Maiduguri and three for Kaduna. Oda locations wia di security outfit claim pipo die include Kano, Kebbi, and Jigawa, all in northern Nigeria.
But di State police command for Jigawa tell BBC Pidgin say nobody die for di state.
“Violent crackdowns on peaceful protesters dey unjustified and unacceptable. Di Nigerian authorities’ hard clampdown on peaceful protests yesterday and di harmful comments by goment officials ahead of di protests appear to dey part of di wider plan to find justification for stopping pipo of di right to peaceful protest,” Amnesty Isa Sanusi tok.
E call on di Nigerian authorities to investigate dia incidents impartially and ensure say security personnel wey dem suspect say dem dey responsible for di alleged deadly use of force dey accountable through fair trial.
Men of di Lagos police command dey present since di protest start for Ojota area of di state.
Early Friday morning, di police tanda for protest ground inside Ojota and oda places wia wahala fit happun.
Di Lagos police public relations officer, Benjamin Hundeyin wit im men bin also dey ground to monitor di situations for Ojota, Lagos state.
Wit fully armed men and uniformed mobile police, di whole area dey secured as all di officers wear dia ‘red band’ for hand.
According to di Inspector-General of police, Kaylee Egbetokun, e say di ‘red band’ wey di policemen dey wear na say dem dey on ‘red alert’.
So far for Lagos state, no case of shooting or teargas. Also, no record of fight, violence or police intimidation for di protest area.
Nigeria former vice president Atiku Abubakar don give im support to di ongoing nationwide protest against hunger for di kontri, as e call on more Nigerians to show solidarity and support for di #EndBadGovernance peaceful protest.
Oga Atiku for one post on im X account say make goment “listen to di voices of di pipo and come down from dia high horses.”
E commend di protesters for di peaceful way dem conduct themselves and beg dem to maintain dia peaceful position. E also torchlight areas wey reports of violence dey.
Di presidential candidate for di Peoples Democratic Party (PDP) during di 2023 presidential election, call on police to engage more professionally and manage di protest.
In di same vein, former Anambra state govnor and presidential candidate of di Labour Party Peter Obi don distance imself from one video wey dey fly up and down say im lead protest for Abuja.
Obi for one statement on im X account say di video na false. E explain say "di pipo wey do dat yeye tin bin edit one video dem take during im visit to di Labour Party headquarter, wia im settle one clash between di party and di Nigeria Labour Congress,.
"Dem edit am well-well to create false narrative," e also allege say dem don pay pipo wey dey responsible to spread dis misinformation.
“Dis misrepresentation na part of one larger narrative of blackmail, wey dey aimed at fiting me into dia malicious agenda
As di protest kontinu for Lagos, some muslim protesters for di Ojota axis of di state observe dia Juma'at prayers for di protest ground.
Fotos show as dem observe di prayer while odas gather dey look.
Market places and oda businesses don open for Enugu State on day 2 of di End bad governance protests.
As di protests dey go on for oda parts of di kontri, di state don come back to 90% normal according to wetin BBC reporter for Enugu witness.
Shops and malls bin dey closed for di first day of protests wey happun across di kontri but dem don open now.
Like many oda south-eastern states, protest no hold for Enugu on Thursday 1 August 2024.
Kano state goment don announce di partial relaxation of curfew for di state.
Now, residents of Kano dey free to go about dia business from 12pm to 5pm from Friday.
Dis announcement dey timely becos e go now allow Muslims for di state to go observe dia Friday Jum'at prayer.
More dey come.
Kano State police command say dem don arrest 269 suspects wey allegedly instigate violence and loot properties during di nationwide protest on Thursday.
Police tok-tok pesin, Abdullahi Haruna Kiyawa, tok say dem recover many jerrycans of 25 Litres of groundnut oil, large quantity of stationeries, foodstuffs, and oda valuable properties wey di suspects loot.
E tok say dem go soon hand di case to di state command criminal investigation department (CID) and dem court afta di completion of di investigation.
BBC Pidgin witness widespread looting for Kano on Thursday as hoodlums bin dey captured inside video wia dem dey run wit household items, mattresses and electrical appliances.
Di state commissioner of police, Salman Dogo Garba tok say make di security agencies continue to dey protect lives and properties while im ask di residents make dem obey di curfew by di state goment.
Wia dis foto come from, Kano police command/ Facebook
Wia dis foto come from, Nigeria Police Force/Facebook
Di Nigeria Police Force don place all units on red alert.
Inspector General of Police for Nigeria Kayode Egbetokun wey announce am say, dis don become necessary sake of di spate of violence wey happun for some major cities across di kontri, wia protesters dey march against bad governance, rising cost of living, inflation, among odas.
E say officers dey fully mobilized and prepared to respond swiftly and decisively to any further threats to public safety and order.
“We remain committed and firm to protecting lives and property and to ensure say law and order dey maintained across di nation.”
Di IGP order dey come afta di protest turn violent for some major cities for di kontri like – Kano, Borno, Yobe, Kaduna, Gombe, Bauchi, FCT Abuja, Niger, Jigawa – and some pipo use protest as disguise to loot and cause havoc.
E confam say four pesins die for Borno state and 34 odas seriously injure sake of one explosion for di state.
Oga Egbetokun say for oda places like FCT, Kaduna, Kano and Gombe among odas, dem record incidents of unprovoked attacks on security personnel, wia report dey say one policeman die and odas seriously injure.
“Dem don let hoodlums loose on innocent Nigerians and dis thugs don destroy dia hard-earned businesses and loot property.
“Di motive of di rioters na two; loot and destroy both private and govment property. Dem don destroy police stations, attempts to take ova goment houses, looting of goment infrastructures, dem don loot several warehouses and shops and completely destroy some.” Egbetokun tok.
Di police oga appeal to all citizens to remain calm and cooperate wit di Police plus oda security agencies during dis challenging period.
Your safety na our top priority, e add.
Wia dis foto come from, Godwin Obaseki/Facebook
Edo State Govnor Godwin Obaseki meet wit EndBadGovernance protesters on Thursday, di first day of di nationwide protest and promise to carry dia message give di kontri president, Bola Tinubu.
Di govnor wey meet wit di protesters for Ring Road for Benin City, say im dey aware of di pains and sufferings Edo pipo and all Nigerians dey face and beg dem say make dem no turn di protest to violence.
"I take God beg una, make una no burn anytin.
“As your govnor, I know you no dey happy. You dey hungry. I dey here to let you know say any message you get for me, I go carry am go Abuja to give Mr. President.
"Di level of hunger dey high, I go take your messages go Abuja," Obaseki tok.
“You say make di President reduce fuel, I go let am know. School fees dey high, I hear una. You say unionists dey cause increase in food prices. Make I know who dey worry una, we go arrest dem.”
Di govnor assure di protesters say dem go work to ensure say prices of food come down.
We go disband agberos and stop dia activities on our roads, e assure dem.
“You say make we fix federal roads and reduce electricity tariffs; I go carry dat one go Abuja for di President to address. I go bring school fees down for Edo State,” Govnor Obaseki add.
Wia dis foto come from, Bosun Tijani/Twitter
Nigeria Minister of Communication Innovation and Digital Economy, Bosun Tijani, tok say goment no give any instruction to network providers to disrupt di internet connection of Nigerians.
Some reports on di internet accuse di Nigerian goment of giving instruction to network providers make dem restrict di internet connection of protesters.
Inside one Interview wit Channels TV, di minister explain say di cause of slow network connectivity wey pipo experience on Thursday fit be as a result of high usage of internet connection by Nigerians, while e deny goment meddling in di disconnection of internet connection to frustrate di pipo.
"No instruction to tamper wit network. You also need to understand wen you get high number of pipo wey no dey work. Pipo dey online. So you go expect di traffic to dey extremely high," di minister tok.
"And I no dey tok say dat na di cause. I neva get any update from operators. We need big infrastructure for Nigeria to get good quality telecommunication and connectivity."
Wia dis foto come from, Babagana Zulum/Facebook
Di Borno State goment don relax curfew for di state. Di curfew go be from 12pm to 3pm on Friday.
From 6am on Saturday, members of di public fit go about dia lawful businesses and shun violence, according to di state police command.
Dis dey come less dan 24 hour hours wey di state goment impose curfew on di state afta di EndBadGovernanceinNigeria protest turn violent for dia.
Wia dis foto come from, @BornoPoliceNG/Twitter
Wia dis foto come from, Siminalayi Fubara/X
Rivers state govnor Siminalayi Fubara don appeal to di end bad governance protesters for di state to exercise patience as goment, "from di top to di state level dey do everytin possible to address di challenges di kontri dey face."
E also thank dem for di peaceful way dem conduct themselves for di first day of di protest.
Govnor Fubara wey address di protesters say im understand wetin kontri pipo dey go through but remind dem say e also dey aware say di exchange rate for di kontri den no be di same as now.
“I understand your feelings, cost of living, food, rent, medical bills, everytin don go up, we understand wetin dey happun but we dey come from somewhere wey dey very bad and goment dey do everytin possible to address dem.”
For day two of di End bad governance wey dey hold across Nigeria, di protesters for Lagos state don return to Ojota.
Di protesters even though dia number don reduce pass di crowd wey come out yesterday still gada to address diasef how today activities go be.
Meanwhile, vehicle movement for Ojota don betta pass day one as cars dey carry pipo to and fro.
Many shops, banks and business entities remain closed on Friday, afta nationwide protest breakout on Thursday in major cities nationwide.
Di protest wey start peaceful in many cities on Thursday become violent wen suspected hoodlums begin hijack am and begin loot private and goment properties in some northern states.
Shop owners begin dey protect dia properties against vandalisation in some northern part of di state.
Security agents also fire live bullets and teargas at some protesters for Kano, wey lead to di state goment declaring 24 hours curfew.
Afta di massive looting by suspected hoodlums wey hijack di protest for Kano.
States like Yobe, Nasarawa, Katsina and Borno also impose curfew for some of di volatile local goment areas for di states.
While some of di curfew na 24 hours, odas na 12 hours.
Protesters come out in dia numbers for a ten-day nationwide protest wey dem tag ‘EndBadGovernaceInNigeria as dem demand for good governance from political leaders in di kontri
Major streets and cities in di south-eastern part of di state remain empty as residents for Imo, Enugu, Anambra, Abia and Ebonyi refuse to partake in di EndBadGovernanceInNigeria protest.
Di protests remain peaceful in major cities for southwestern region states of Nigeria as demonstrators continue to demand for good governance.
© 2025 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.