https://vast.yomeno.xyz/vast?spot_id=1471086

Bobrisky win Best Dressed Female award for event – Portable, oda celebrities react – BBC

Spread the love

Wia dis foto come from, Bobrisky Instagram
Nigeria celebrities dey react afta Bobrisky win best dressed female award for di Lagos premier of ‘’Ajanaku: Beast of Two Worlds’’.
Bobrisky wey im real name na Okuneye Idris Olarenewaju dey identify as woman.
She beat Ogbonge Nollywood stars like Toyin Abraham, Mercy Aigbe, Sola Sobowale wey attend di premier to win di Best Dressed female award and collect one million naira.
Di event take place on Sunday March 25 for Circle Mall for Lekki area of Lagos.
Bobrisky totori di judges wit her black shine-shine gown, big curly hair and black lipstick for di movie premiere.
End of Di one wey oda users dey read well well
Na Big Brother Naija Level Up contestant Groovy win di ‘Best Dressed Male’ award.
She begin trend afta pipo including celebs begin chook mouth for di mata.
Wia dis foto come from, Bobrisky/Instagram screenshot
"Na so I hear say dem give Bobrisky best female dressed for movie shey na woman no be artificial'' Nigerian musician portable tok for for video im post for social media.
Nollywood actress Dayo Amusa say: “I go one of my colleague premiere yesterday, dem say dem go award di best dressers; one female and one male best dresser. No get me wrong oh, di winner fit be anybody but definitely no be crossdresser. I mean, wetin dey worry us? I no understand.
“I no fit imagine say di judges disrespect every woman dia. You need to pick a winner, one female best dressed and a male best dressed and you water di efforts of all di women for di event by giving di best dressed female to one crossdresser. I no understand, wetin dey wrong wit us?
“If you feel say you wan honour crossdressers, you for create dia own category instead of disrespecting women to give crossdresser di best dressed female award.”
Daniel Regha say: ‘’Dayo Amusa dey right, Bobrisky winning di "Best Dressed Female" for event na insult to every female attendees wey bin dey present; But di organisers no be di only ones wey dey at fault, blame those wey joyfully or play- play acknowledge am afta di disrespect’’.
Wia dis foto come from, Getty Images
Pipo begin reason Bobrisky for 2016 for Nigeria just as snapchat start to become popular for di kontri, she begin trend sake of her cross-dressing.
To capitalize on di move, Bob bin enta Snapchat wit Premium wia im bin dey charge Nigerians N10,000 to view di platform.
Since den, she don dey in di middle of a lot of controversy wey include di recent one wit im former bestie, ogbonge actress Tonto Dikeh.
Bob don also cause controversy wit all di claims of plastic surgeries to become woman as well as, all di advice im dey give young women about how to meet rich men dem.
Bobrisky don also rise to become one of di biggest Instagram influencers for Nigeria wit almost five million followers.
© 2025 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.

source

Leave a Comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

G-EMT04799R8
Scroll to Top
 anecdote : ronald reagan’s impact : a visionary leader who embodied conservative values.