Wia dis foto come from, Getty Images
Tems don win her first individual Grammy Award for di 2025 edition of di global ceremony.
Tems win award for di Best African Music Performance winner wit her hit single "Love Me Jeje".
She beat Burna Boy, Chris Brown, Davido, Asake, Yemi Alade and odas to emerge winner.
"Dear God, thank you so much say you put me ontop dis stage and give me dis team," Tems tok for her acceptance speech.
She add say "Tomorrow na my mum birthday, and na she dey here for her first Grammys, and I just wan thank you, mum, becos she don really do a lot for me and my brother."
Wia dis foto come from, Getty Images
Temilade Openiyi wey pipo sabi as Tems, na Nigeria producer, musician and songwriter. She start her music career as teenager during her practice days wit her music teacher Mr Sosan for Dowen college in Lagos in di year 2011.
She spend her first four years for United Kingdom with her mother and papa bifor dem divorce, her mama den return back to Nigeria to raise Tems and her broda for dia small apartment in Badagry, Lagos.
Tems bin dey work as Digital Marketer for Lagos afta her BSc degree in Economics from Monash University in Johannesburg, South Africa.
In 2018, Tems resign from her job and release her first single 'Mr Rebel' but she rise to fame in 2020, wit her collaboration wit Wizkid on di song 'Essence'.
She don collect several international and local awards and recognitions for her music. Her latest, "Love Me Jeje" na one on di songs for her 2024 album 'Born In The Wild'
Dis na Tems Journey into winning di Grammy in 2025.
For 2023, Tems collect her first Grammy award for Best Melodic Rap Performance wit 'Wait For You', wey feature Drake for di 65th Annual Grammys.
For 2025, Tems get a total of eight nominations, wit "Love Me JeJe" wey win Best African Music Performance.
She also dey nominated for Best R&B Song wit "Burning" and Best Global Music Album wit "Born in the Wild."
Tems na 29 years old.
Wia dis foto come from, instagram/ @Davido @yemialade
Among di Nigerians wey congratulate Tems for winning di Best African Music Performance category na Labour Party Presidential candidate for di 2023 election Peter Obi.
E tok say dis na big success for Nigerian youths for various fields, especially for di entertainment sector.
"I like to therefore to extend my hearty congratulations to our Nigerian Afrobeats star, Tems, wey just secure her second Grammy Award wit her win in di Best African Music Performance category," e tok.
Also, Davido and Yemi Alade wey dem nominate for di same category 'Best African music performance' also congratulate her for di Grammy award.
"Congratulations to di winner @temsbaby," Yemi Alade tok.
"Congrats Queen!" @davido tok for im Instagram post.
Dis na di second year wey Grammy don add dis category. Last year na Tyla win wit her song 'Water'
Best African music performance
Winner: Tems – Love Me JeJe
Yemi Alade – Tomorrow
Asake & Wizkid – MMS
Chris Brown ft Davido & Lojay – Sensational
Burna Boy – Higher
© 2025 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.