https://www.effectiveratecpm.com/a6p10zefz?key=9fbeb1c0f20d8ad103ffe05e6fa26abb www.akapi.xyz

Kidnapping in Abuja: Police say Nabeeha sisters don regain freedom – BBC.com

Spread the love

Wia dis foto come from, Adamu Asiya
Di Nigeria police don confam say di victims of di Bwari Area Council wey happun for Abuja, Nigeria capital for January don regain dia freedom.
Jaguda pipo on 2 January, 2024 bin attack di Zuma 1 Area inside Bwari Area Council, Abuja wia dem kidnap pipo wey include di family of Nabeeha and her sisters.
Di death of Nabeeha for di kidnappers hand bin lead to public outcry as pipo begin ask questions about di safety of di Federal Capital Territory.
But di FCT Police Command for inside statement on Sunday 21 January, 2024 wey tok-tok pesin Josephine Adeh sign, confam di rlease of di victims by di anti-kidnapping squad and troops from di Nigerian Army.
"Di Federal Capital Territory Police Command anti-kidnapping squad joinbodi wit troops of di Nigerian Army, on di heels of di kidnappers wey strike di Zuma 1 Area, Bwari Area Council on di 2nd of January 2024.
End of Recommended articles
"Di FCT Police don rescue di victims and reunite dem wit dia families.
"Di operatives successfully rescue di victims around Kajuru forest for Kaduna State at about 11:30 pm on Saturday 20 January 2024," police tok for statement.
Police add say dem deploy di newly inaugurated Special Intervention Squad, wey don increase di existing security architecture of di FCT.
One X user wit di handle @Adamu _Asiya also tweet about di release of Nabeeha sisters.
Im post say, "Dem get released last night. Tank you all for una efforts and prayers.
"Make una no forget Nabeeha and Uncle Abdulfattah for your prayers. May Allah forgive dia shortcomings and grant dem Aljannatul Firdaus."
Di X user bin dey also do a day to day count of how long di victims stay for di hand of di kidnappers.
Dis news sweet di belle of Nigerians wey begin react immediately to di post.
Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Twitter post, 1
Content is not available
Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Twitter post, 2
Content is not available
Afta di tori of di kidnapping of Nabeeha and her sisters plus oda family members, di jaguda pipo begin ask for ransom for dia. release.
Dis lead to one crowdfunding campaign wey currently shele on X to raise moni for five sisters wey di bandits bin kidnap wit dia papa for Abuja on 2 January.
Di bandits later release di papa, Mansoor Al-Kadriyar, make im go hustle moni for ransom payment.
Na six sisters di bandits bin kidnap, but one of dem, Nabeeha Al-Kadriyar die. Di bandits kill her sake of say di family no raise enough moni for di ransom on time.
Di family bin get less dan 72 hours to hustle N100 million – N20 million for each of di five sisters wey still dey alive.
Dis moni dey even higher dan di N60 million wey di bandits bin request. And dem bin give dem new deadline wey be Wednesday, 17 January.
Even though police no tok weda dem pay rason or not, di X user @Kabiru_aminucome out to tank pipo wey support dem for im post.
Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Twitter post, 3
Content is not available
Di Nigerian Senate bin amend di terrorism prevention law for April 2022, including one clause wey tok say payment of ransom to kidnappers go dey illegal, and anybodi wey pay ransom fit spend 15 years for prison.
Di lawmakers argue say e go "discourage as kidnapping and abduction for ransom take dey rise for Nigeria", but many Nigerians no gree.
"Payment of ransom no be di problem here, na kidnapping be di problem," Imran Rufai, wey bandits kidnap im brother for inside di Abuja-Kaduna train attack of March 2022, tell BBC dat time.
However, di clause wey criminalise ransom payment no later make am into di version of di terrorism prevention bill signed into law by President Muhammadu Buhari for May 2022.
According to one report by SBM Intelligence for August last year, kidnappers demand ova ₦5 billion in ransom payments from Nigerians between June 2022 and June 2023, but na only around ₦302 million pipo pay.
Di recent kidnap of one Alhaji Mansoor and im six daughters on Tuesday night for dia house for Bwari Area Council, Abuja on 2 January, 2024 bin spark fresh tok-tok about di return of insecurity to Nigeria Federal capital territory.
Insecurity for Nigeria don turn anoda tin especially for Abuja – in recent times.
Di FCT Police Command bin don give assurances to residents say make dem go about dia legal duties and make dem no fear.
"Di Commissioner of Police FCT Haruna Garba, wish to reiterate im unflinching commitment to make sure say di FCT remain a safe and peaceful place for residents to stay witout fear from any quarters of di Territory," Police tok inside one of dia recent statements wey tok-tok pesin Josephine Adeh sign.
But di reality be say di more police give assurance di more dis crimes dey happun.
On Saturday 20 January, 2024, tori bin fly upandan say kidnapping bin dey go on for one big estate along Airport Road, but police tok-tok pesin for di FCT Police Command Josephine Adeh for statement explain say na staged kidnap.
"Di FCT police Command dey aware of di news making rounds about one alleged kidnapping incident for River Park Estate for di early hours of today (Saturday) and wish to state say contrary to reports, dem no kidnap anybodi for River Park Estate.
One Nnandi Agu of Games Village only fake im own kidnap in an attempt to defraud im broda wey dey live within di said Estate.
Di suspect currently dey police custody dey undergo interrogation and investigation still dey go on "
Meanwhile, one security expert wey follow BBC Pidgin tok suggest some ways wey dis crime go fit reduce.
Oga Mike Ejiofor tok say di insecurity no dey affect Abuja alone, and Abuja na part of Nigeria.
E say di jaguda pipo wey dey do dis tin no dey do am sake of economic issues for di kontri.
Im dey wonder say "if na true-true na hunger or suffer dey make dem kidnap pipo, why dem dey kill dia victims even afta some families don pay ransom?" im ask.
Oga Ejiofor add say dis jaguda pipo aim na to bring down any goment so dat di pipo go begin fear.
"I personally dey worry too say dis tin dey happun for di seat of goment, somtime ago we bin tok about Nasarawa, Niger, Kaduna and Kano and neighbouring states, but see am now e don enta di Federal Capital Territory.
"Dem dey try to make goment unpopular to undermine di confidence wey pipo get for goment.
"Goment bin don give plenti assurances on di use of technology, but e be like say di technology wey dem deploy no dey work well," e tok.
Im explain say di only solution to dis crime wey dey happun na for goment to localise police.
"Police no get enof manpower, dem no dey fund dem properly, so make we get state police, so dat di state govnors wey be di number one security officer go take charge of dia states, but dis one dey for National Assembly hand, dem need to make law wey go establish state police," Oga Ejiofor tok.
Oga Ejiofor wey be former Director General of State Security Service (SSS) explain say di new trend wey most states and communities dey use to fight crime na local vigilante and dey good and effective but dem dey limited sake of say local vigilante no dey carry arms.
"Di arms wey vigilante dey carry na arms wey dey easy to get license for, but dis jaguda pipo dey carry AK47, AK49, Rocket launcher, so how you expect dem to confront dis jaguda pipo wey carry dis kain arms?" im ask.
E also tok say anoda way to reduce crime na for goment to liberalise firearms to some of di established vigilante groups and make police monitor dem strictly so dat dem no go abuse am.
Im add say citizen get dia role to play too, "if anybodi see anytin make dem tok sharp sharp.
© 2025 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.

source

Leave a Comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

www.akapi.xyz
Scroll to Top