https://vast.yomeno.xyz/vast?spot_id=1471086

Nigeria national anthem: Old national anthem Nigeria we hail thee lyrics as Tinubu approve dropping of Arise o compatriots – BBC.com

Spread the love

Wia dis foto come from, Ajuri Ngelale/BBC
President of Nigeria Bola Tinubu don sign into law di bill wey return di kontri to dia old national anthem.
Di bill wey now don become Act, go see Nigerians return to dey sing di old national anthem titled “Nigeria, we hail thee”.
Di Senate President Godswill Akpabio bin reveal dis during di joint session of di National Assembly.
During di joint session to celebrate Silver Jubilee (25 years) of Nigeria 4th Republic see President Tinubu later join di session.
Na for during di joint session Tinubu confam say “Nigeria we hail thee” go be di “latest anthem”.
End of Recommended articles
“Dis morning, Mr President sign into Act of parliament di newly passed national anthem 2024.” Akpabio tok.
Di Senate President read di new national anthem “Nigeria we hail thee” from one paper wey dey im hand.
Shortly afta, President Tinubu for im address to di lawmakers say "You bring out di latest national anthem, Nigeria we hail thee. Dis na our diversity, representing all characters and how we blend togeda to be brodas and sisters."
President Tinubu also tok on how di pipo gatz dey togeda as a nation.
"No amount of assistance from any oda nation fit help us, make we work togeda to build our nation for generations yet unborn."
According to di Act, di ministry of information go "organise di review and approval of standard performance of di national anthem, and record di official recording of di national anthem to be played.
Also, di recorded version of di new national anthem go dey published for goment website and e go be part of di civic education for pupils and students to learn for school.
Wia dis foto come from, NASS TV/Youtube
Di Nigeria National Assembly pass bill wey go make di kontri make u-turn to return to her old national anthem on Tuesday.
Di Bill push for Act to drop di current national anthem “Arise o compatriot” to go back to “Nigeria we hail thee” wey di kontri first adopt afta independence for 1960 – but later drop for 1978 wen former President Olusegun Obasanjo bin be military leader for di kontri.
Nigeria, we hail thee,
Our own dear native land,
Though tribe and tongue may differ,
In brotherhood, we stand,
Nigerians all, and proud to serve
Our sovereign Motherland.
Our flag shall be a symbol
That truth and justice reign,
In peace or battle honour’d,
And this we count as gain,
To hand on to our children
A banner without stain.
O God of all creation,
Grant this our one request,
Help us to build a nation
Where no man is oppressed,
And so with peace and plenty
Nigeria may be blessed.
Na mixed reaction for many Nigerians afta di announcment official adoption of 'Nigeria we hail thee' as di new anthem.
While some pipo welcome di decision of President Tinubu to sign di reversal to di old nathional anthem into law wit mix feeling, odas complain say as di kontri dey face inflation at 33% so, national anthem no suppose be di priority for law makers.
Odas dey wonder how dis reverse to old anthem go take stop insecurity and di suffer wey dem dey face.
E also get odas wey feel say dem dey too old to begin dey learn new anthem.
Wia dis foto come from, Pearls/X
Wia dis foto come from, Oby Ezekwesili/X
Wia dis foto come from, Oluseun Onigbinde/X
Wia dis foto come from, Osi/X
Wia dis foto come from, Kamal T/X
Wia dis foto come from, Oseni Rufai/X
Wia dis foto come from, Nefertiti/X
Wia dis foto come from, Odanye Olumafemi/X
© 2025 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.

source

Leave a Comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

G-EMT04799R8
Scroll to Top