Trump latest picks for top roles: Linda McMahon, WWE former CEO and Mehmet Oz wey be TV Dr Oz na Donald Trump nominees for White House jobs – BBC.com

Spread the love

Wia dis foto come from, Getty Images
US President-elect Donald Trump don pick former World Wrestling Entertainment (WWE) CEO Linda McMahon, as im nominee for education secretary.
McMahon wey also be Trump transition co-chair go dey expected to handle di education sector for di United States.
McMahon na long-time Trump ally wey bin lead di Small Business Administration during Trump first presidency and donate millions of dollars to im presidential campaign.
Trump don criticise di department of education, and e promise to close am down, but now McMahon fit get di job afta Trump return to di White House for January 2025.
Trump also choose Mehmet Oz, wey be celebrity doctor and former TV host wey im approach don come under serious tok to lead di Centers for Medicare and Medicaid Services (CMS).
Dis two selections for Tuesday wit Trump choice of Howard Lutnick for commerce secretary dey follow a pattern of di president-elect to nominate im loyal supporters to top roles for im cabinet.
McMahon get a long history wit di WWE and Trump dey make occasional appearances during wrestling matches.
She co-found Titan Sports wit her husband for 1980 wey later become di parent company of WWE years later.
She resign as CEO for 2009 so she go fit undertake a failed bid to run for di US Senate.
McMahon get little background for education, but she bin serve for Connecticut state board of education from 2009 until 2010.
She be di board chair of di pro-Trump think tank, di America First Policy Institute, wey mean say to confam her for di Republican-majority Senate dey possible.
Her own post na one of di top jobs wey go require a vote of approval for di upper chamber of Congress.
Wen Trump dey announce her pick for Truth Social, e write: “For di past four years, as di chair of di board at di America First Policy Institute, Linda na serious advocate for parents rights."
E say McMahon go lead di effort to "send education BACK TO DI STATES", e dey refer to im promise to close di department.
Republicans don accuse di education department of pushing wetin dem describe as "woke" political ideology on to children, including on gender and race.
Dem want make di agency authority dey di hand of US states wey dey run most education matters.
McMahon dey named for one lawsuit wey dem file last month wey involve di WWE.
Di case allege say she, her husband and oda company leaders knowingly allow young boys to dey abused by a ringside announcer wey die for 2012.
Di McMahons deny evri wrongdoing. One lawyer wey dey represent di two of dem bin tell USA Today Sports say di allegations na "false claims" wey come from "ridiculous, bad tok and e lack merit" .
Wia dis foto come from, Reuters
Trump earlier pick Mehmet Oz to run di powerful agency wey dey oversee di healthcare of millions of Americans.
Oz wey dey selected to lead di CMS dey trained as a surgeon bifor finding fame for Di Oprah Winfrey Show for di early 2000s.
Oz don dey criticised by experts for promoting wetin dem call bad health advice about weight loss drugs and "miracle" cures, and suggestion of malaria drugs as a cure for Covid-19 for di early days of di pandemic.
“E no fit get any physician wey dey more qualified and capable dan Dr Oz to make America healthy again," Trump tok for statement.
Di Trump transition team tok for statement say Oz "go work closely wit [health secretary nominee] Robert F Kennedy Jr to take on di illness industrial complex, and all di horrible chronic diseases wey dey left".
Like McMahon, Oz go need to dey confirmed by di Senate next year bifor e officially take charge of di agency.
Di CMS oversee di kontri largest healthcare programs, wey dey provide coverage to more dan 150 million Americans.
Di agency regulate health insurance and set policy wey go guide di prices wey doctors, hospitals and drug companies dey pay for medical services.
For 2023, di US government spend more dan $1.4tn (£1.1tn) on Medicaid and Medicare combine, according to di Congressional Budget Office.
Trump tok for statement say Oz go “cut waste and fraud within our kontri most expensive govment agency”.
Di Republican Party platform promise to increase transparency, choice and competition and expand access to healthcare and prescription drugs.
Oz wey be 64 years na trained cardiothoracic surgeon wey specialise for operations on di heart and lungs – and work for di New York City Presbyterian Hospital and Columbia University.
Afta e appear for dozens of Oprah segments, e bin start Di Dr Oz Show, wia e dey share health advice to viewers.
But di line between promotion and science on di show no dey always clear, and Oz don recommend homeopathy, alternative medicine and oda treatments wey critics don call “pseudoscience”.
Dem criticise am during Senate hearings for 2014 for endorsing unproven pills wey e say go “literally flush fat from your system” and “push fat from your belly”.
During those hearings Oz say e neva sell any specific dietary supplements for im show.
But e don publicly endorse products off air and im financial ties to health care companies dey revealed for fillings made during im 2022 run for di US Senate in Pennsylvania.
During di Covid-19 pandemic, Oz promote di anti-malaria drugs hydroxychloroquine and chloroquine, wey experts say e dey ineffective against di virus.
© 2025 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.

source

Leave a Comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

G-EMT04799R8
Scroll to Top
Die website verweist auf das restaurant la bodega 77, erreichbar über https : //labodega77.